Jump to content

Kofi Adu: Difference between revisions

From Wikipedia
Content deleted Content added
Created by translating the page "Kofi Adu"
(Difference no dey)

Revision as of 01:17, 28 August 2024

 

Alexander kofi Adu (born May 25, 1969), dey originally comot Ashanti Region of Ghana but he dey live for Accra Newtown ein suburb called Asantewaa,[1] chaw people know am as Agya Koo. He be actor plus comedian for Ghana. He be one big star for kumawood, plus he act for over 200 Ghana movies, wey dey include Obaatanpa, Away Bus, Black Star, plus Ma Tricki Wo.

Ein Career

Kofi Adu come from Ashanti Region for Ghana, but he dey live for Accra Newtown, wey dem dey call Asantewaa. He be cobbler, dey repair shoe. Dem discover Adu for 1995 on one Ghana comedy show (Key Soap Concert Party) wey dey GTV (Ghana National Television) for National Theater for Accra, where he dey work as comedian, dey warm up crowd before dem stage de main drama.

For July 2008, den give am National Award from de former President John Agyekum Kufuor. But originally, he come Accra to sing, not to act. Agya Koo don act for plenty Ghana movies, but 15 of dem be him favorite.

Agya Koo no dey follow de normal way wey actors dey follow, wey dem go read script well before dem go start dey act for film insyd. He tell Joy FM's former morning show host Kojo Oppong Nkrumah say, normally, dem dey give actors script two weeks before dem start shoot, but him own talent wey God give am, allow am to improvise without script.

He dey act movies plus Aboagye Brenya, Lil Win, Kwaku Manu, Mercy Aseidu dem chaw odas.[2]

Ein Personal life

For June 2016, Agya Koo marry again to Rita Asiedu for London, UK, after dem date for 4 years. He bin marry before to Victoria Owusu Adomako, but dem divorce. He be Christian.[3]

Ein Net worth

Agya Koo, de famous Ghana actor, get estimated net worth wey dey between $500,000 plus $700,000. Ein net worth make am one of de richest actors for Ghana. He get all ein money for ein plenty movie roles, endorsements, sponsorships, plus oda tins wey he dey do. He own music band plus film production studio wey dem dey call Tetemmofra. He act for over 100 movies. He show ein new mansion for 4th June 2023 for Kumasi.

Filmography

 

  • Key Soap Concert Party
  • Agya Koo Gbegbentus
  • Three Desperate Friends
  • House of Commotion
  • Evil Heart (2008) - John
  • Kumasi Yonko (meaning - Kumasi Friendship) (2002)
  • Obi nnim awie ye (meaning - No one knows the end)
  • Ka wonan toso (meaning - Sit properly)
  • Asew 419A (meaning - In-law 419A)
  • Business Partner
  • Gyina Pintin (meaning - Stand Firm)
  • Bone So Akatua (meaning - Rewards of Evil)
  • Obaatanpa (meaning - Good Mother)
  • Black Star (2006)
  • Otan Hunu Kwah
  • Ma Tricki Wo (meaning - I have tricked you)
  • Agya Koo Trotro Driver (2012)
  • Joni Waka (2012) - Paa Nii
  • Ohia (meaning - Poverty)
  • Away Bus (2019) - Moses
  • Nsem Pii (meaning - Many Issues)
  • Sure banker
  • Bosom Ba
  • Kwadwo Besiah
  • Sika ye Mogya
  • Nyame Bekyere1&2
  • Agya Koo Mechanic
  • Aburokyire Abrabo (meaning - Life Abroad)
  • Agya Koo Bank Manager
  • Asem Aba Fie (meaning - An Issue at Home)
  • Kankan Nyame
  • Onyame Asem
  • Agya Koo Gyae
  • Kayayoo
  • My Soldier Father
  • Obidea Aba (meaning - It's the turn of another)
  • Nnipa Sei Nnipa (meaning - Humans destroy themselves)

References

  1. https://www.ghanaweb.com/person/Agya-Koo-570
  2. https://starrfm.com.gh/2021/10/kumawood-actor-agya-brenya-reported-dead/
  3. http://www.ghanastar.com/news/kofi-adu-aka-agya-koo-remarries-in-london/
  • Kofi Adu at IMDb